LYRIC

[Verse 1]

I rather drink garri as
Free man for basin,
Dan to dey eat fried rice
And chiken for slavery,
I might blow today tommorow
Or next maybe,
Married to the game
This rappers na ashwebi,

No guts no glory
Confam for phyno,
Life no fair
I go bleach am till E ton abin0,
We all go blow last last
Bros na turn by turn,
If you watch your pot my bros
Your food no go burn,

I do this song for my guys
Wey no dey sleep for night,
Hustle with keyboard for dark
Until you see the light,
Drop of water steady
Go make river last last,
One day na one day
We street boys go blow last last.

Chorus (Mc sweetheart)
As I dey
Hustle for the money….
I dey hustle the fame O…
According to my mummy
Always kneel down and pray…
Me no send anybody
Am all about the game O…
Am all about the game
Cuz I know last last I go blow.(x2)

Verse 2

I rather dey like lion
Dey rule my jungle,
Dan to be dog for city
I no fit fumble,
Success to me na sure
I no dey hope for luck,
If I no get the key to success

I go break the lock,
I hustle for money
Wey to big for pocket,
But no be all rain wey fall,
Dem dey put bucket,
That year if young boy craze
Dem go say na gbana,
Shey na the gbana
Dey make boys dey crase for ghana,

The law of gravity
No dey work for 9JA,
What goes up no dey come down
Bros for this 9JA,
The country hard
Igbo man call me bia,
He was like you know
How many boys die for libya,

I no say bed no dey heaven
God no dey sleep,
Na him give us leg to trek
He go still give us jeep,
Drop of water steady
Go make river last last,
One day na one day
We street boys go blow at last.
(But till then)

Verse 3

No matter how
Cow squeeze face my guy,
The truth be say
He no go fit threaten fly,
Every young boy for street
Get dreams to fufill,
How wish you step in to my shoes
To see how I feel,

My back be like net now
Too much holes,
Back stabbers don turn
My back to goal post,
Betrayers in the air
Who am I to trust,
Lord show me the way don't
Allow me to get lost,

Na money I want make
Why these boys dey make mouth,
Carry mic begin
Dey clam king of the south,
If dog see watin pass bone
He go run live bone,
Back to the matter
That topic for now I bone,

Last last
Dem go halla my name like jayz,
2PAC and biggy
Even lil wizzy,
Cuz drop of water one day
Go make river last last,
One day na one day
Area fada go blow at last.

Added by

Admin

SHARE

Your email address will not be published. Required fields are marked *

ADVERTISEMENT